Showing posts with label PIGIN POEM. Show all posts
Showing posts with label PIGIN POEM. Show all posts

Sunday, 24 July 2011

Sisi

Sisi wey dey go – hope you dey look road
Make you no go fall and break your waist.
Rub powder small-small for face, but no
take am cover sense, go land for disgrace.
Sisi wey dey pass – hope you know say some
Eyes dey count your steps, easy make you no fall.
Carry smile decorate your lips, why you go wear
 frown, When happiness no dey cost kobo.
Sisi wey dey look – shine your eyes well-well,
no be everything wey dey shine fit be gold.



Copy Right Ahmed Dodo
2011.

Tuesday, 12 July 2011

Dis Lagos

Dis lagos self the thing I don take my eyes see , no be small my brother.

I see many people everyday as dem dey run with time, take style wan over take the thing.

Dis lagos no easy my sister , na plenty story dey fly everyday with wings, na so many mind no dey sleep.

Ha! dis lagos self , the roads plenty, I beg shine your eyes make molue no carry you go-go dump for lagoon.

Dis lagos big , na so many yellow - yellow colour dey push man for road, money dey pose dey do yanga.

Dis lagos good - na there water dey, wey dey carry different story about.

Dis lagos wide, everyday na different drama dey dance for road and so many people dey do their things.

Saturday, 9 July 2011

No Wahala

Dey don break, another day of waka,
worries, wishes and wants.

No Wahala -carry - go wetin go be,
na him go still happen.

Wetin you go do? how you go do?,
How e go be? or e fit happen so?

No- Wahala - carry go - why you dey
trouble your mind, when no be you
create yourself or get the day.

Night don dey come, how tomorrow
go be?, wetin go happen today?

No- Wahala- relax your mind ,carry
smile tear your face, and happiness
for pocket , today never end.