Tuesday 12 July 2011

Dis Lagos

Dis lagos self the thing I don take my eyes see , no be small my brother.

I see many people everyday as dem dey run with time, take style wan over take the thing.

Dis lagos no easy my sister , na plenty story dey fly everyday with wings, na so many mind no dey sleep.

Ha! dis lagos self , the roads plenty, I beg shine your eyes make molue no carry you go-go dump for lagoon.

Dis lagos big , na so many yellow - yellow colour dey push man for road, money dey pose dey do yanga.

Dis lagos good - na there water dey, wey dey carry different story about.

Dis lagos wide, everyday na different drama dey dance for road and so many people dey do their things.

No comments:

Post a Comment